As Akwa Ibom State dey celebrate di 37 years wey dem create am, Engr. Oto-Obong Essien, wey be PDP Chairmanship candidate for Ikono Local Government Area, don hail Governor Pastor Umo Eno for di way e dey carry everybody along for governance and e effort to bring unity and peace for di state.
For di special interdenominational thanksgiving service wey dem do to mark Akwa Ibom anniversary and Nigeria 64th independence, Engr. Essien talk say di way Gov. Eno dey lead, don make peace dey for di state even as di country dey face plenty wahala for economy.
As she dey talk, Engr. Essien yarn say di governor sabi how to work with everybody, no matter party, and e dey do partnership well well with di federal government. She talk say,
“I dey proud as I see how our Governor dey run di government wey carry everybody along. I thank am for di way e dey push development wey go help all di people for di state.”
Essien, wey dey contest for Ikono LGA chairmanship seat wey election go hold for October 5, 2024, still talk say she dey hapy as Gov. Eno give women better chance for leadership. She yarn say, “Di only way wey person fit make im papa happy na to follow im good example. I go try my best for Ikono, and I thank Gov. Eno as e give women chance for governance.”
She come praise di governor for wetin e do for education sector, especially di ARISE Edutrip wey carry 39 students from rural schools go UK for better learning. She believe say di trip don show how di state dey invest for di future of di youths, and e go bring better things later.
As di state dey celebrate dis milestone, Engr. Essien don promise say she go follow Gov. Umo Eno footstep to bring better development and leadership wey go touch everybody for Ikono if dem elect her.
© Emmanuel Ufon
Comr Imaobong Umoekah
For StàndbyNetwork