As Akwa Ibom dey prepare for di Local Government election wey go happen for October 5, 2024, Mkpisong Frank Archibong, wey be Commissioner for Local Government and Chieftaincy Affairs, don promise say Ward 2 Central go give PDP 100% support. Di Commissioner talk say di ward don stand gidigba for PDP since 1998, and dis year no go different.
For di PDP ward tour wey dem do for St. Paul’s Lutheran Primary School field, Ikot Ibiok, Eket, on Wednesday, October 2, 2024, Archibong talk say Ward 2 Central don ready well-well to give PDP di highest number of votes. As crowd full di field, e show say di people ready to vote for PDP come election day.
“Dis ward na PDP backbone for Eket, and we go make sure say PDP collect all di votes. See as everybody turn up today, e show say we dey united for di party,” Archibong yarn.
Archibong no forget to hail Governor Umo Eno, wey him call di ‘people’s governor’. According to Archibong, di plenty projects wey di governor don do for Akwa Ibom don already do di work, so PDP no need do plenty campaign again. “Pastor Umo Eno na our chief campaigner. Him work dey speak for am. Wetin we dey do today na just to show say we dey support am and di Arise Agenda,” Archibong talk.
Archibong still carry di opportunity take support Mkpisong Akaniyene Tommey, wey be PDP chairmanship candidate for Eket LGA. Him praise Tommey say na leader wey sabi, wey don show correct leadership for human capital development, infrastructure, and tourism for di past three years. Archibong promise say if Tommey win, him go focus on education, healthcare, and better things for di community.
“Tommey na di right person for di job. Him don show say him fit lead well, and Governor Umo Eno don give him full support. If we support Tommey, na better we dey support for di whole Akwa Ibom,” Archibong add.
Di event no stop for only political talk, as di women leaders like Dr. Mrs. Bright Archibong and Mrs. Maryann Tommey also appreciate di role wey women dey play for leadership. Dem thank Governor Umo Eno and Eket stakeholders for di opportunity wey women get for positions like female vice-chairmanship and councillorship. Di women promise say dem go deliver their own votes for PDP.
As di event dey near di end, Mkpisong Akaniyene Tommey collect di official PDP victory flag, wey cement him position as di strong candidate for di Eket Chairmanship.
Di event no end without di presence of di Councilorship candidate of di ward, Mrs Rose Sylvanus with odas big political dignitaries like PDP Chapter Chairman , Uso Hanson Chapter Secretary, Elder Samuel Okon, Dr. Tommy Enodien, and many other notable PDP supporters.
Di atmosphere
for di event show say di people of Ward 2 Central no get any doubt for di leadership of Governor Umo Eno and di PDP.
With di kind unity and determination wey dem don show, di October 5 election no go be hard for PDP to win for Ward 2 Central.
Comr Imaobong Umoekah
For StàndbyNetwork