SBNPIGIN TORI ::: 20112024  ChristmasVillage:Redeemyasef,Govnor Umo Eno Tell Commissioner

SBNPIGIN TORI ::: 20112024 ChristmasVillage:Redeemyasef,Govnor Umo Eno Tell Commissioner

 

SBNPIGIN TORI ::: 20112024

ChristmasVillage:Redeemyasef,Govnor Umo Eno Tell Commissioner

 

Govnor Pastor Umo Eno don para for wetin dey happen for di 2024 Akwa Ibom Christmas Village, and e don tell di Commissioner for Tourism, Mr. Charles Udoh, say make e “redeem yasef.”

Govnor yarn dis one wen e dey launch waste disposal equipment for Akwa Ibom Waste Management Agency office. E talk say anybody wey dem catch dey resell di kiosks wey goment set price for 100,000 naira go collect serious punishment.

“Some people buy di shops for 100k, come dey resell am for 300k. I don get correct tori say some people buy di shops cheap and dey add di price. If anybody tell you make you pay 300k, abeg report di person give Barr. Morgan Ekanem, wey be my Senior Special Assistant, and we go arrest am sharp-sharp.

“People no fit dey use goment goodwill take make profit. Honourable Commissioner for Tourism, abeg, fix dis matter. Redeem yasef, redeem your name. Di kiosks no fit pass 100k, na di price we goment don agree,” di Govnor tok.

E still hail Prince Ikim for di work wey e dey do to make sure Akwa Ibom clean well-well, and e tell am make e continue di good work so di state go remain di cleanest for Nigeria.

Di equipment wey dem launch na: five waste compacting trucks, four waste swing arm trucks, one pull-up truck wey get crane, fifty 6000 liters Dumpster, six 1,200 liters Dumpster, and others.

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *