PRESIDENT TINUBU PRAISE GOVERNOR ENO ACHIEVEMENTS 

PRESIDENT TINUBU PRAISE GOVERNOR ENO ACHIEVEMENTS 

PRESIDENT TINUBU PRAISE GOVERNOR ENO ACHIEVEMENTS 

SBNPIDGIN TORI | 03032025

 

President Bola Ahmed Tinubu don hail Akwa Ibom State Governor, Pastor Umo Eno, for him leadership and the way him dey committed to the development of him state. The President describe Governor Eno as correct Governor wey fear God and love for him people.

President Tinubu talk this one when him receive 104-member delegation from Akwa Ibom, wey Governor Eno and Senate President Gods’will Akpabio carry follow body, for the Presidential Villa for Abuja.

The President stressed say leaders for the country suppose focus on national development, no matter the political party wey dem belong to. Him talk say Nigeria go only reach him full potential if everybody dey united and dey work together.

 

Senate President, Senator Godswill Akpabio, also praise Governor Eno for the way him dey bring unity for Akwa Ibom, and him assure Governor Eno say Akwa Ibom people go fully support am for him effort to push Nigeria forward. Akpabio talk say political leaders for Akwa Ibom go continue to work for reconciliation and collaboration.

Governor Eno, for him own side, present him 20-month scorecard to the President, and talk about some key things wey him need help with, like support for Ibom Deep Seaport development and intervention for ecological challenges.

 

The high point of the visit na when Akwa Ibom traditional rulers give President Tinubu the highest title for the state, “Otuekong” (Grand Commander of Akwa Ibom State), as part of the ceremony wey the supreme council of Akwa Ibom State Traditional Rulers, led by Oku Ibom Ibibio III, Ntenyin Solomon Etuk, do.

 

The meeting also get attendance from political, traditional, and religious leaders, former ministers, lawmakers, and representatives of youth and women groups, e show say everybody dey united across party lines.

 

Comr Imaobong Umoekah

For StändbyNetwork

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *