SBNPIDGIN TORI | 10032025 FOR INSIDE AKWA IBOM
… thank Governor Umo Eno well well for appointing their spouse as Commissioners and Special Advisers.
… promise say dem go work with di First Lady Designate.
Wives of Commissioners and Special Advisers for Akwa Ibom State, don reaffirm say dem go commit dem sef to help Pastor Umo Eno bring im ARISE Agenda come true for we state.
Dem make the public know their position for di inaugural meeting for Uyo on Monday, March 10, 2025.
For di event, di President of Commissioners & Special Advisers Wives Association, Akwa Ibom State Chapter and di wife of di Commissioner for Local Government and Chieftaincy Affairs, Dr. Mrs. Bright Archibong – thank Governor Umo Eno for di opportunity wey im give their spouses to serve di good people of Akwa Ibom.
She talk say Governor Eno na true gender-friendly governor and leader, wey dey passionate about developing our state and taking am to greater heights.
COSAWA members, promise say dem go support di First Lady Designate, Lady Helen Obareki, by backing all di activities of di Golden Initiative For All (GIFA) and by collaborating with all stakeholders to improve the lives of women, children, and vulnerable groups for di state.
Dem also take dis opportunity to thank di Dean of Commissioners, Rt Hon Frank Archibong, for im papalious support and guidance. Dem pray make God endow all di honorable commissioners with wisdom to interpret di Governor’s ARISE AGENDA, and dem pray make God protect His Excellency the Governor, di First Lady Designate, and di entire Akwa Ibom State.
Imaobong Umoekah
For StändbyNetwork