Gov Umo Eno Don Boost Akwa Ibom Economy, Empower Entrepreneurs and Scholars

Gov Umo Eno Don Boost Akwa Ibom Economy, Empower Entrepreneurs and Scholars

SBNPIDGIN TORI FOR INSIDE AKWA IBOM | 11032025

Gov Umo Eno Don Boost Akwa Ibom Economy, Empower Entrepreneurs and Scholar

Dis na one bold move wey go strengthen entrepreneurship and education for Akwa Ibom, Governor Umo Eno don give over 10,000 sets of equipment to 2,000 small business people wey dey work for various sectors. Dis ARISE Entrepreneurial Equipment Support Scheme na to promote self-reliance and open up more economic opportunities for di people.

Di people wey dey do tailor work, welding, shoe-making, people wey dey wash cloths, hair dressers, and plenty other areas don receive di working tools wey go help dem scale up dia businesses. Governor na beta person, dem even distribute 77 mini buses and 31 saloon cars to boost transportation for di state.

No be only entrepreneurship na im dey on di agenda – Governor don also reward academic excellence. Students wey sabi book and professionals wey dey shine for dia fields also collect cash support: N10 million for one WAEC top guru, full sponsorship for one Medical Doctor wey score 10 distinctions to pursue Masters for obodoyibo, and N15 million for people wey win debate for international school. Even one female tipper truck driver, Otobong Philip Udoh, she gets N5 million for breaking gender barrier for dis male-dominated trade.

For di Uyo Township Stadium, Governor Eno yarn say him go continue to strengthen our state economy through MSME support, humanitarian intervention, and education-driven empowerment. Him hail President Bola Tinubu for im economic policies, and say di best legacy of him administration na di number of lives wey dem don transform positively.

Top government officials, party leaders, and business stakeholders show plenty appreciation for di governor’s approach, call am a sustainable model for economic and social development. Di beneficiaries sef thank and promise say dem go use di resources well to grow dia businesses and contribute to our state growth.

Gov Umo Eno’s leadership don set new standard for governance – putting di people welfare, economic growth, and empowerment of future leaders for front.

 

Comr. Imaobong Umoekah

For StändbyNetwork

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *