SBNPIGINTORI ::: 11112024
Tori don show say di Children Recreational Park for di ARISE Park wey dem dey build go ready for use by December 2024.
State Governor, Pastor Umo Eno, tok dis one wen im waka go Dominic Utuk Avenue, Uyo, wey dem dey do di project.
Im talk say di Golf Course don complete, and dem dey test am before dem go open am officially for December.
Governor Eno still yan say di gully erosion wey almost wan destroy houses for di area don stop, and di work dey go well.
“Every time we come here, we dey see big difference. E mean say di contractor dey meet di milestone, and we dey happy.
“For me, we don already achieve our main purpose. Di gully erosion no dey spread again, e no dey destroy people house and life. Di dream to get recreational park don dey turn reality small small.
“I dey happy, di contractor don assure us, and I believe say him go still tok him own. For dis Christmas wey dey come, we go fit open some part of dis project, especially di children park. We dey work make e happen for dis Christmas period.
“Di Golf course don ready and I hear say people don dey test am and practice. Na good news be dat.”
Gov Eno praise di contractor for di way dem dey handle di work, and tok say di contractor don key into di vision of di recreational park project.
Di Managing Director of Bulletine Construction Company Limited, Chief Faysal Harb, still support di December deadline. E talk say, “We dey go as we plan, like His Excellency don talk, part of di facility go dey ready dis December, especially di Children playground, football field, lawn tennis, Basket and Volley ball pitches. All di sport facilities go ready for use dis December.”
Di Governor waka wit Secretary to di State Government, Prince Enobong Uwah, and other top government officials.
Comr. Imaobong Umoekah
For StàndbyNetwork