Tori for town be say political waka for Akwa Ibom State don dey hot as PDP don start dia local government election campaign for Ikono Local Government Area. The event wey happen on Saturday na part of the preparation for the October 5th local government council election, and PDP use di opportunity take give flag to dia Chairmanship candidate, Hon. Engr. Oto-Obong Essien, plus the twelve councilorship candidates.
Di campaign wey dem do for Ikono Council Secretariat field pull plenty crowd—PDP supporters, traditional rulers, community leaders, youths, and women all show face, promise support for the PDP candidates. For this election, Engr. Oto-Obong Okon Essien go run as chairmanship candidate, while Ukai John Bassey na im go be vice-chairmanship candidate, with twelve councilorship aspirants.
PDP State Chairman, Hon. Aniekan Akpan, talk for the rally say Govnor Umo Eno dey committed to develop Ikono LGA. He remind the people say di govnor don promise to repair the 21.5-kilometer Ikot Ayan Ediene/Nkwot/Nung Ukim road network wey get 45-meter bridge, as part of im plans for better infrastructure for the area.
Akpan come praise Govnor Eno for the work wey im don do—roads, housing, schools, agriculture, health insurance, and pension for retirees. He talk say, “Oga govnor don give me power to assure una say all di project wey im start for Ikono, e go finish dem. Today, we get female chairmanship candidate, which show say govnor dey balance gender for im governance.”
Plenty big people for Ikono like Hon. Asuquo Nana, political leader Sir S.U. Akpan, and Senator Aloysius Etok follow talk, all dem dey confident say PDP go win for the October 5th election. Dem promise say dem go work hard to make sure all PDP candidates win for the election.
Engr. Oto-Obong Essien wey be the chairmanship candidate thank Govnor Umo Eno and Ikono people for giving her the chance to carry PDP flag. She promise say if dem elect her as chairman, she go lead well and make sure the area develop well well.
The high point for the event na when dem give flag to all the PDP candidates, show say the party don ready for the election, and dem sure say dem go get good result.
As Ikono dey prepare for the election, PDP believe say with the strong support wey dem see for the campaign launch, success sure for their side.
©By Emmanuel Ufon
Imaobong Umoekah
For StàndbyNetwork